Wednesday 14 June 2017

Streetwise with angel - Who Ultimatum help?

Abeg make we yann  the tori for the language we all of us fit read. Who the ultimatum help. For this obodo Nigeria wey we dey so all the ethnic groups just like to dey show themselves say naa them sabi. All of them don forget say the giant of Africa wey we be na untop say we big, we plenty and we dey together as a nation so who the ultimatum come help.


Make we start from the Biafra people wey start the break away wahala, he be like say them don forget all the sufferness wey them suffer for the Biafra war ,the way dem take force do things no follow for modern democrazy, make we put that one for one corner. The Igbo don contribute much for this country economy, so tee no be them suppose they carry bag say them wan comot. Them don forget them investment wey dey outside their territory pass the one wey dey their domot. For them mind them think say their hosts across the country go allow them pack all their money go? Naa the thirst for power of individual naa be the reason for them agitation and that one no follow for the common man wey dey umukoro village.

Kai na that point naa some Aboki come wake up from north come dey give ultimatum, no be them fault wen dey suppose go school go learn; naa cattle dem dey follow up and down. Who dem ultimatum help? Upon all the wahala wey dey ground! Them Papa Emir Sanusi dey talk to them head say make them become proactive like the Igbo and Yoruba, them put cotton wool for ear them abi? Naa them dey give ultimatum to people wey dey sustain business for them land? Una like underdevelopment and poverty so?

You know this kind time Yoruba people go dey form "elite" wey sabi book, you go dey hear English for and against. Naa from another corner some people come dey talk make we too waka now. Help me ask them say to where? Una don forget say naa una dey consume all the thing wey Hausa/Fulani they rear and plant. Nna una they buy and use the thing wey omo Igbo they produce for aba. Hope you know say if una break the way wey hunger go take wire una for the first few years eh. Even Oduduwa go tell una say he no send una make una go collect republic..

The wahala wey dey ground pass the one wey we dey give ourselves ultimatum. Look at our leader for Government them we dey give ourselves ultimatum. Them dey sit together chop our money dey go. Naa the hand wey no get work naa in devil dey work with sebi the unemployment wey dey ground cause am.

Make we borrow ourselves sense make Government set up Graduate Farm Settlement scheme for all of us for obodo Nigeria. Make them reduce political office holder money and make them pay civil servants well. Make them reduce the number of foreigners wey dey come here come work when we never see work do. Make Government reduce school school fees wey dey go up and do things wey go reduce cost of living for Nigeria because the poverty don dey too much. Make them no dey use mouth tell us say them fight corruption make them dey fight the corruption make we they see am with our korokoro eyes. Naa for these things we suppose they give collective ultimatum as Nigerian Youth.

Make Baba God bless Obodo Nigeria.

No comments:

Post a Comment